Mr chairman , accurate time keeper, impartial panel of judges my fellow friends,my Co Debator,all protocol duly observe
My name is my name and I am here to propose d notion dat says
(Nobody senior any body,life naa turn by turn ) with my following reasons
(1) Dem first born u no mean say u go first die
(2)if u first me touch ceiling because u tall,I go first u to pick stone from d ground because I near ground pass u
(3) u fyt first me enter ss1 and I fyt first u enter University
(4) small boy wai just finish school fyt begin work before chairman wai do NYNC 2015
(5) u help me today no means say I no fyt help u tomorrow
(6) person wai dey healthy fyt die before person wai dey sick
(7) naa oga dey pay driver but AC go first blow driver before e reach oga for back
(8)u dey stay upstairs no mean say naa u near God pass
(9) wen u see me naa wen I see u
(10) time keeper,as u want to ring dat bell may ur time in dis world never be over
I hope with dis very few point of mine I should be able to convince u not to confuse u dat(nobody senior anybody for dis life ,life naa turn by turn
Thank u 😘😘
Yesooo that’s how life is
Ewwwooooo
Hmmmmm
Lolz
Bravo madame
Good one