TRANSFER TORI

 

As transfer window don close for midnight, dis na some of the last transfers wey shele before the deadline expire:

 

Antoine Griezmann don return back to him ex, Atletico Madrid from Barcelona on top 1 year loan deal with option for Atletico to buy am with 40 million euros. The bros go begin collabo with him former teammate, Suarez so dem go dey cook the kind soup wey dem be dry cook togeda for Barca.

 

Ronaldo don join Manchester United from Juventus on top 19.8 million pounds bride price and 2 years marriage contract with option to extend am. As e be now, Ronaldo don become the highest paid player for EPL with salary of £480,000 pounds a week.

 

Hector Bellerin don join Real Betis from Arsenal on top one year borrow-borrow contract. Arteta no get plan to dey play dis bros for match so instead of make him dey chill for bench, the bros decide to use him teeth take count him tongue and carry him kaya run leave husband house.

 

To replace Bellerin, Arsenal don complete the signing of Japanese defender, Takehiro Tomiyasu from Bologna on top 20 million pounds contract. According to wetin we hear, Arteta like dis guy because e fit play for central or right back therefore him na utility.

 

Leeds United don pay 25 million pounds bride price give Manchester United to take sign dem winger, Daniel James on top 5 years contract.

 

To replace Ronaldo, Juventus don collect Moise Kean from Everton on top 2 years borrow-borrow contract with option to buy the bros on top 24 million pounds bride price. Kean join Everton from Juve as a youth sensation but e be like the bros bullet finish as e enter Everton so dis na opportunity for am to return home and gather more bullets.

 

Meanwhile, Chelsea don finally pay 5 million euros take collect Saul Niguez from Atletico Madrid on top one year loan with option to buy the bros. Chelsea pursuedis bros taya and dem go surely happy say dem collect am.

 

Real Madrid don use 34 million pounds take sign 18 years old wonder kid, Eduardo Camavinga from Rennes on top 6 years marriage contract. Many big clubs like United wan sign dis boy but Real Madrid rush collect am because dem believe say na the boy go replace Luka Modric las las.

 

Tottenham don complete the signing of Barcelona right back, Emerson Royal on top 25.7 million pounds bride price. Arsenal sef been hustle to sign dis boy but him prefer Tottenham instead.

 

Leicester don collect Naija boy, Ademola Lookman from Leipzig on top season long loan. We hear say na dis Europa League wey dem wan play inside make Leicester decide to add the boy join dem squad.

6 Comments

Leave a Reply

Your email address will not be published.